NA THE TRUTH BRO
sheybi you know
life is not a bed of roses
you must work before you chop
but if grace dey for you
you go chop belleful and you no work
sheybi dem yarn you
love is everything in this life
make nobody whine you my bro
love is not enough
common sense and ego dey importanter
sheybi you dey see am for street
orientation is everything
you must dey calculate right left and centre
book is not enough
if you no get street OT you no wise
sheybi you dey shine teeth
babe tell you say she love you, you dey blush
no yawa bro, your eye go soon peel
babe wey dey give street on a steady
you wan fall in love with? continue
sheybi you dey see am for news
our government this, our government that
audio workings and Ai projects
lying up and down, thinking say we be mumu
e go soon be for them, aje
sheybi e dey evident
this government no send anybody papa
borrow borrow sote dem don run us streets
no yawa, that day don almost come
men go mount, e go be
sheybi their pikin dey see am
how their papa and mama dey move anyhow
when he reach our turn to vex
we no wan hear “I am sorry”
hand go touch them, even their unborn pikin
@talk2leigh
(X & insta)
6:56am
22 Oct 2025



Comments
Post a Comment